Di plan of Nigeria track queen, Favour Ofili to switch di kontri wey she go dey represent from Nigeria to Turkiye no work at all.
For September 2025, Favour bin announces say she don port from Nigeria to Turkey.
E bin mean say for big world sporting events like Olympics, World Athletics na Turkey she go dey represent on di international stage.
But di plan no work as di World Athletics Integrity Unit rejects her international transfer from Nigeria to Turkiye.
For di document wey carry di decision wey di panel wey dey in charge of international transfer bring out, dem tok say “Di Application by di Athletics Federation of Turkiye (TAF) for Favour Ofili (di “Athlete”) to transfer allegiance from Nigeria to Turkey no dey approved.”
E mean say di 23 years old go continues to represent Nigeria for international events.
Favour wey dey run 200 metres for Nigeria bin no happy wit di Athletics Federation of Nigeria (AFN).
Wen she bin announce her switch to Turkiye, she bin tok for her post last year say, “I dey proud say I don represent Nigeria for many years in highly successful way! I don win SIX gold medals, TWO silver medals and TWO bronze medals in championship meets and 200-meter Olympic finalist while experiencing di biggest disappointment from AFN and NOC towards me”.
How AIU judge di case
World Athletics Integrity Unit say according to dia Eligibility Rules, wey bin start on 15 August 2022, di rule tok say, “World Athletics fit, in dia sole discretion, refuse to give dia approval to transfer of allegiance application if World Athletics reasonably believe say di reason wey di council bring to regularize di transfer of allegiance dey compromised…”
Di panel say afta dem review di application, declaration of di athlete and di written answers wey di TAF bring on 24 November 2025 di analysis wey members of di panel make and di reply wey di athlete give in line wit dia regulation go “compromise dia main rules and regulations.”
“Because di application no dey approved, di athlete no dey entitled to transfer allegiance to TAF and no dey eligible to represent Turkiye for National Representative Competitions (World or Area Championship Events, Olympic Games, etc) or oda relevant competitions.
For July 2025, di Turkiye Athletics Federation bin file applications for transfer of allegiance for eleven athletes from Kenya, four from Jamaica, one (Favour Ofili) from Nigeria, and one from Russia. Dem bin submit di application on 04 July 2025.
AFN welcome Ofili back
Di Athletics Federation of Nigeria (AFN) don officially welcome Favour Ofili back wey signal fresh chapter for di relationship between di athlete and di federation.
For statement, AFN President Tonobok Okowa happy well-well as she comeback.
“Di focus now na to provide di right environment for di 100m and 200m star to shine, na wetin she needs di most from stakeholders and “love, support, encouragement and more love.”
AFN say dem go rebuild di trust and strengthen dia athlete relations ahead of major international competitions. Ofili return dey expected to boost Nigeria sprint prospects.
Profile of Favour Ofili
Ofili na one of di top young athletes for Nigeria, she bin rise from junior rank to senior rank.
Ofili wey from Port-Hartcourt, Rivers State, start her journey from di U-20 women category wia she bin compete and win medals for Nigeria.
According to di World Athletics, Ofili currently rank as di sixth best woman for di 200m race and 28th best for di 100m woman race.
For 2022, Ofili win silver medal in di Women’s 200m race of 2024 Olympics Games for Paris.
For di 2022 Commonwealth Games Championship for di Women’s 4x100m Relay, Favour Ofili, Rosemary Chukwuma, Grace Nwokocha, and Amusan win gold for Nigeria.
She also participate for di 2021 World U-20 Championship for Nairobi wia she win bronze for di 200m women category.
Ofili performance win her global brand sponsorship and scholarship.